If you wan buy dollar for black market today, you go need to bring N1440 to collect 1 dollar. But if na you wan sell dollar, dem go give you N1450 for each dollar wey you carry go there. Na wetin our people for Bureau De Change (BDC) yarn us be dat.
E get as CBN talk say make dem take do official exchange rate for dollar to naira, but e no be the same tin with wetin dey happen for black market. If you go black market, dem go sell give you pass as dem take dey sell for official market.
Black Market Exchange Rate Today
Dollar to Naira | Black Market Exchange Rate |
---|---|
Buying rate | ₦1440 |
Selling rate | ₦1450 |
CBN Official Exchange Rate Today
Dollar to Naira | CBN Rate |
---|---|
Buying rate | ₦1414 |
Selling rate | ₦1415 |
But make I remind una say Central Bank of Nigeria (CBN) no dey recognize black market at all at all. Dem don already yarn say if anybody wan buy or sell forex, make e go meet im bank.
Na so e be, my people. If you wan change your money, make you shine your eye well well o!