Site icon PidginNews

Gbege for Lagos Island! Two-storey building collapse, plenty people trap inside

Building collapse Lagos

Tori be say, one two-storey building don fall for Isale Eko area of Lagos State and e don cause plenty fear and alarm for di area.

Dem say plenty people dey trapped inside di building wey dem say no dey strong before.

Di way wey di building take strong sef don spoil afta fire burn some parts of Dosunmu Market for Lagos Island.

Oga Ibrahim Farinloye, wey be di Lagos Oga for National Emergency Management Agency, NEMA, confirm di tori and e say di fire affect 14 oda buildings well-well.

For April, four buildings bin collapse sake of how di fire take burn some part of Dosunmu Market for Lagos Island.

Oga Farinloye say emergency people wey dey for di place wey di thing happen na NEMA, Federal and State Fire Service, Nigeria Police and fire service of di Nigeria Ports Authority.

Exit mobile version