Site icon PidginNews

8 Pesins Wey Dey Pray Don Die, 28 Dey Hospital Afta One Man Burn Mosque For Kano

Kano wreckage

Very sad thing don happen for Kano, as dem don confam say eight pesin don die, afta one man wey no dey happy wit how dem share im papa property, carry fire enta mosque wia dem dey pray.

According to wetin one tori pesin wey no wan make dem mention im name tok, na six adults, one small pikin and one teenager na im die.

E say na 32 pesin dey involve for di mata and 28 of dem dey hospital dey receive treatment while four of dem get small injury.

As e dey tok, “As we dey tok so, we dey di graveyard now. From di time wey di tin happen reach now (evening), like eight pesin don die.

“We don bury two and di remaining six dem dey carry dem go burial now. Di victims na dose wey dem rush go Murtala Specialist Hospital.

“Plenty of dem dey for emergency unit for Murtala Specialist Hospital and odas dey main ward. But I hear say dem still cari some oda pesins go Aminu Kano Teaching Hospital, AKTH.

“All di worshippers get difren kain injuries. All of dem na 32 and 28 dey hospital. Dose wey dia own no too serious, dem don waka go house.”

Before dis one, di Assistant Inspector General of Police, Umar Sanda, bin first tok say na only one pesin die.

Di AIG confam di death wen im visit di hospital wia di victims dey wit oda security ogas dem, di Commissioner of Police for di state and di Director of Department of State Service, DSS, and odas.

Im say: “Wetin happen no get anytin to do wit terrorism but na fight wey burst sake of how dem share property.

“Di suspect say im no dey happy wit how dem take share di tin and na wetin make am vex. Im dey wit us now dey give us beta info. Out of di 24 wey dem admit here, na only one die. E really sad o. Na locally made bomb im take do di tin.”

Exit mobile version