Site icon PidginNews

Court No Gree Give Binance Oga Tigran Gambaryan Bail

Tigran Gambaryan

One Abuja Federal High Court on Friday don dismiss di bail application wey di Binance oga, Tigran Gambaryan, wey dem don detain, file.

Justice Emeka Nwite, for im ruling, tok say based on di affidavit evidence wey dey before am, Gambaryan go jump bail if dem grant am di application.

“I don look di affidavit evidence wey dey before me well well and I dey see am say di applicant go jump bail if dem grant am bail,” na wetin Justice Nwite declare.

However, di judge give order say make dem do di trial sharp sharp.

News Agency of Nigeria (NAN) report say Justice Nwite bin don, on April 23, fix Friday for di ruling afta EFCC lawyer, Ekele Iheanacho, and Gambaryan lawyer, Mark Mordi, SAN, adopt dia processes and argue dia case against and for di bail plea.

Justice Nwite bin don order say make dem keep Gambaryan for Kuje Correctional Centre afta e plead say e no dey guilty to di money laundering charges wey EFCC gbab am.

EFCC bin accuse Binance Holdings Limited, Gambaryan and Nadeem Anjarwalla, anoda agent of di company, say dem allegedly dey conspire amongst demsef to hide di origin of di money wey dem get from dia alleged unlawful activities for Nigeria including $35,400, 000.

Dem alleged say dem commit offence wey dey contrary to Section 21 (a) and e dey punishable under Section 18(3) of di Money Laundering (Prevention and Prohibition) Act, 2022, among odas.

However, Anjarwalla escape from lawful custody on March 22 and e run comot from Nigeria go Kenya.

Mordi, on top Gambaryan mata, bin file application dey find order of di court, to release im client on bail pending di hearing and determination of di main case.

Mordi, for di last adjourned date, bin argue say EFCC fail to bring any better evidence to oppose im application.

According to am, di complainant allegation say Gambaryan dey arrange to escape from custody like im colleague na lie lie.

“No exhibit or document dey wey dey show EFCC better intelligence.

But EFCC lawyer no gree wit Mordi.

Iheanacho argue say di court go dey take big risk if dem grant di Binance agent bail because e no get any attachment to any community for Nigeria or beta pesin to stand as im surety.

E contend say Gambaryan try to apply for new United States passport wen e dey detention knowing well well say dem don seize im International passport by Nigerian state.

Di lawyer say e be flight risk and if dem grant am bail, e go jump bail like im colleague.

E no gree wit Mordi say di commission neva provide beta evidence say Gambaryan dey plan to escape.

E say as e be for dia counter affidavit, di deponent na one of di investigative team wey investigate di case.

E beg di court make dem dismiss di bail application.

If not, e advise di court say make dem return di applicant to EFCC custody if di judge decide to grant am bail.

Exit mobile version