Site icon PidginNews

Cross River Assembly speaker don chop impeachment because of money mata and incompetence.

Elvert Ayambem

Tori don land say di speaker of Cross River state house of assembly, lvert Ayambem, don lose im position sake of money mata and im no fit do im work well.

Di mata happen for Wednesday plenary wen Honorable Effiong Ekarika wey dey represent Calabar south 1 constituency raise di motion say make dem remove di speaker. Honorable Omang Charles of Bekwarra constituency support am for di motion.

Even before Wednesday, e be like say plenty members no dey happy with di speaker. As at Tuesday, dem say more than 20 members don already sign to comot am for office.

Afta dem don vote finish to remove di speaker, di members come carry di mace comot to avoid any oda kasala.

Dis na serious mata wey don happen for Cross River state house of assembly and e go dey interesting to see how everytin go take play out for di coming days.

Exit mobile version