Site icon PidginNews

Festus Keyamo talk say Nigeria Air was not Nigerian Air

Festus Keyamo

Festus Keyamo wey be di oga for di ministry of aviation and aerospace development don yarn say di Nigeria Air matta neva move from where dem stop am.

For 2023, di ministry of aviation wey Hadi Sirika bin dey lead before, show us Nigeria Air — just three days before President Buhari comot office.

Dis one cause plenti wahala for di kontri as pipo dey ask who get di airline sef. Ethiopian Airlines carry 49 percent share, federal goment hold 5 percent, come be like say na only 46 percent remain for Nigerian investors dem.

Di mata reach house of rep and dem no gree at all. Dem tok say make goment stop di operation of Nigeria Air, say na scam.

Oga Keyamo come outside for August 2023 con tell us say dem don pause di national carrier tin till further notice.

As e dey update us for di press briefing wey happun for Abuja to mark one year wey Presido Tinubu don dey for office, Keyamo still tok say di project neva start.

“E still dey on top suspension. No be Air Nigeria at all. Na lie dem dey lie. Na only paint dem take paint am Air Nigeria. Na Ethiopian Airlines just dey try use our flag dey fly,” na wetin e tok.

“If na so e be, why dem no go allow our own pipo to dey fly our flag? Wetin come bring foreigner to dey fly our flag? So make nobody argue am say na Air Nigeria.

“Air Nigeria must to dey kampe, e must be Nigerian own well-well, and e must bring beta beta tins come give Naija, no be to dey share 50 percent of di gain to anoda kontri.”

Keyamo still talk am again say di way dem arrange di ownership of di airline wey dem bin wan start, e no go benefit us for dis kontri at all at all.

Exit mobile version