Site icon PidginNews

FG carry 36 govnors go supreme court ontop LGA autonomy mata

supreme court nigeria

De Federal Goment don drag all de 36 state govnors go Supreme Court sake of how dem dey take run Local Goment Areas anyhow. Na de Attorney General of de Federation (AGF) and Minister of Justice, Lateef Fagbemi, file de case make e grant full autonomy to all local goment areas for de kontri.

For de case, Federal Goment tell Supreme Court make dem give order wey go stop state govnors from just dey remove local goment leaders wey dem elect. Dem sue de govnors of all de 36 states through dia Attorneys General.

De case still dey ask make court give order wey go allow make de money wey dey for local goment account enta dia hand directly from federation account as e dey for constitution, instead of de yeye joint account wey govnors dey use now.

Federal Goment still beg Supreme Court make dem stop govnors from to dey put caretaker committee to dey run local goment instead of to allow democracy wey constitution talk.

Dem still apply for order of injunction wey go stop govnors and dia people dem from to dey collect, spend or play with money wey dem release from federation account give local goment wen dem no put elected local goment system for state.

For de 27 reasons wey dem give for de case, Federal Goment argue say na 1999 Constitution as dem amend am na im create Nigeria as federation, and na president be head of federal executive arm, wey swear to obey wetin dey inside constitution.

Federal Goment tell Supreme Court say na govnors dey represent de states for federation and dem don also swear to dey obey constitution.

Dem say Nigeria constitution recognize federal, state and local goment as three levels of goment and na from federation account dem dey take money run dia office.

“Constitution talk say dem must get elected local goment system and e no make any oda provision for how to take govern local goment apart from elected local goment system.

Even with wetin constitution talk, govnors no gree put elected local goment system even wen dem no declare state of emergency to warrant make dem suspend democratic institution for state.

As govnors no gree put elected local goment system, dem dey deliberately violate de 1999 constitution wey both dem and president swear to uphold.

All de effort to make govnors follow wetin 1999 constitution talk about to put elected local goment system no work and to continue to dey share money from federation account give govnors wen dem no get elected local goment na to dey undermine de constitution.

Sake of how dem dey violate de 1999 constitution, federal goment no get obligation under section 162 of de constitution to pay any state money wey suppose go local goment wen dem no get elected local goment system for ground.”

Supreme Court don fix May 30 to hear de case.

Exit mobile version