Site icon PidginNews

House of Reps say make CBN no start to dey collect cybersecurity money

Nigeria House of Representatives

Di House of Representatives don tell Central Bank of Nigeria (CBN) on Thursday say make dem stop to dey collect di cybercrime money wey dem bin wan start to dey collect, say make dem follow wetin di cybercrime Act talk.

Dis one happen afta Minority Leader Kingsley Chinda, wey be PDP member from Rivers, carry one motion of urgent public importance come.

Chinda talk say section 44 (2a) of di Cybercrime Act don already list di pipo wey suppose pay di money, and na GSM and telecom companies, Internet providers, Banks and oda financial institutions, insurance companies and stock exchange.

Di lawmaker come explain say di circular wey CBN release don make plenti Nigerians dey fear, e still talk say e be like say na Nigerians go pay di money for dis time wen dem still dey struggle wit how petrol price don increase, and oda tins.

So, di House come ask CBN make dem comot di circular wey dem bin release about di money quick-quick, come release anoda one wey go follow wetin di Act talk.

Exit mobile version