Site icon PidginNews

Kasala for Abia! Gun Men Kill Two Soja, Burn Patrol Van As Dem Enforce Sit-At-Home

Gun Men

Tori dey fly say some gun men wey dem no know don kill two soja as dem dey force people to no comot for house on Thursday.

Di gun men attack di soja dem for Obikabia junction for Aba, Abia State. Dem be like 15 wey cover dia face come set di soja patrol van on fire.

One video wey dey trend for internet show as di gun men dey shoot anyhow before dem burn di soja van.

Later, one soja come show for di video, and person wey dey video am dey cry say “e be like say na only am survive; dem don kill di rest.”

Di gun men use one big SUV jeep and Sienna do di operation.

As at di time wey we dey report dis tori, Abia State Police Command and di Military never talk anything about wetin happen.

South-East dey under lock as Biafra people don declare sit-at-home to remember dose wey die during di Civil war.

Exit mobile version