Site icon PidginNews

Labour Vex Reject Federal Govment Offer Of ₦48,000 As Minimum Wage

nigeria labour congress

Di Organized labour on Wednesday vex comot from di minimum wage committee meeting with Federal Govment afta dem offer dem ₦48,000 as new minimum wage.

Make we remember say di organized labour bin ask for ₦615,000 as di new minimum wage and dem give govment deadline of May 31 to finish di negotiate for di new living wage.

Di Tripartite Committee on New National Minimum Wage continue dia negotiate on Wednesday.

Representatives of di organized labour wey include Nigeria Labour Congress, NLC and Trade Union Congress of Nigeria, TUC, vex well-well sake of wetin govment offer dem.

Professor Theophilus Ndubuaku, one of di people wey dey rep NLC tell Vanguard say, “we ask dem if di ₦45,000 na for transport, food, cloth, house or wetin.”

“So we just tell dem say since dem no dey serious, e beta make we just comot, so we vex comot from di place.”

Im talk say na di Permanent Secretary, Secretary to di Govment of di Federation Office na im give dem di govment offer.

Exit mobile version