Site icon PidginNews

Lyrics of di old Naija national anthem

nigerians

As Presido Tinubu don sign di bill wey go bring back di old national anthem, we for Pidgin.news don decide to give una di lyrics make we fit begin dey learn am. Make Naija live long o!

Plenti people dey argue say di lyrics of di old national anthem get beta meaning and e dey unite us pass di new one.

Nigeria, we hail thee,
Our own dear native land,
Though tribes and tongue may differ,
In brotherhood we stand,
Nigerians all are proud to serve,
Our sovereign motherland.

Our flag shall be a symbol,
That truth and justice reign,
In peace or battle honour'd,
And this we count as gain,
To hand unto our children,
A banner without stain.

O God of all creation,
Grant this our one request,
Help us to build a nation,
Where no man is oppressed,
And so with peace and plenty,
Nigeria may be blessed.

Make we dey sing dis old national anthem wit pride for our heart and make e dey remind us of di beta tins wey we fit achieve wen we stand togeda as one Naija. No mata our differences for tribe or tongue, na brotherhood go make us strong. We go serve our motherland wit everytin wey we get and make sure say our flag dey always stand for truth and justice.

Na our duty to give our children betta Naija and na so we go take build nation wey go sweet us and our pickin dem. We dey pray say God go helep us build kontri wey oppression no go dey and wey peace and plenti go full everywhere. Naija go dey blessed and we go dey proud of our nation. Make we join hand to make am happen, my people!

Exit mobile version