Site icon PidginNews

Man kill im cousin and childhood friend for rituals

Ritual killer

One 39-year-old man wey dey sell fruit, Dolapo Babalola, don confess how e take kill im cousin and four of im friends for rituals for Okeigbo, wey dey for Ile-Oluji/Okeigbo Local Government Area of Ondo State.

Babalola, wey dem parade with 18 oda suspect criminals, tok say e use dia body parts do rituals.

As e dey answer questions from journalists, Babalola explain how e take kill im victims dem and comot dia body parts for rituals.

According to di suspect, e dey always attack okada riders by collecting dia bikes from dem and den kill dem wen im victims recognize am.

E add say e dey attack im victims with stones and sticks wen dem recognize am afta e don drag dia motorcycles with dem.

E say e don dey dis kind yeye business since 2021, and dem dey carry out dia operations for inside di town and di neighbouring states.

“I don kill five pipo, including my cousin and my friend and I collect dia motorcycles. I kill Opeyemi, wey be my friend and I sell di motorcycle give one man for Ibadan wey dem dey call Toheed.”

“I no dey sell human parts but I carry part of one of my victims’ bodies go give one native doctor for Ondo, wey promise me say e go give me Ifa Oracle.”

“For di point wia we dey collect motorcycles, anybody wey struggle with me for di process dey chop big stone and stick for head,” na wetin Babalola tok.

As e dey parade di suspects dem, di state Commissioner of Police, Abayomi Oladapo, say: “Afta dem arrest one Babalola Daniel, wey carry police go one shallow grave for Okeigbo wia dem dig comot di dead body of Opeyemi Oyelakin, wey be okada rider, dem don arrest oda suspects wey get hand for di matter.”

“As dem continue to torchlight di mata, e come show say di suspect don kill four pipo for different places and e steal dia motorcycles.”

“For April 2023, e kill one okada rider for Kabba, Kogi State and anoda one for Ife along Ilesha road for Osun State and e comot some parts from dia dead body for rituals.”

“For June 2023, e kill anoda okada rider for Ondo town and dump di dead body inside farm for Oboto bush along Bolorunduro road, Ondo town, and for October 2023, di suspect and one Sikiru Mutiu, aka S.K deceive im childhood friend wey im name na Joel Olagoke make e carry dem for im motorcycle go one location wia dem kill am, cut im body to pieces and give native doctors: Mujeeb Lawal and Shina Ojo (wey dey police custody now), for rituals,” na wetin e add put.

Exit mobile version