Site icon PidginNews

Nigerian man wey carry 200g cocaine chop arrest for Kenya

Nigerian man kenya arrested

Detectives don catch one Nigerian man wey dem say dem find 200g of cocaine for im hand for Mombasa, Kenya.

Di Directorate of Criminal Investigation (DCI) talk for statement on Thursday, May 9, 2024, say di suspect wey dem call Victor Chinenye Ikonne, chop arrest for one apartment as dem still dey find drug traffickers for di kontri.

Dem talk say, “Di Anti-Narcotic Unit (ANU) detectives wey dey Mombasa don arrest one Nigerian man wey dem find 200g of cocaine wey fit reach Sh600,000 for street.”

Dem still talk say, “Dem arrest di suspect wey dem identify as Victor Chinenye Ikonne afta intelligence operation wia police enta im house for White House Apartments for Utange-Kisauni area.”

“Wen dem search di house, dem find di white powder wey dem wrap inside polythene bag for drawer for im bedroom.”

“Wen dem test di powder, e show say na cocaine true-true, and dem keep am wit oda tins wey dem suspect say im dey take package di drugs.”

“Dem still find plenty SIM cards wey be Airtel, Safaricom, Telecom and MTN own.”

“Dem don carry di suspect go Port Police Station make dem process am before dem go court.”

Exit mobile version