Site icon PidginNews

Nnamdi Kanu Wife Visit Am For DSS Cell

Nnamdi Kanu

Uchechi Kanu, wey be di wife of di leader of di Indigenous People of Biafra, IPOB, Nnamdi Kanu, don go see di Biafra agitator for Department of State Services, DSS, cell.

She yarn say na Anambra South Senator, Ifeanyi Ubah, na im help her visit Kanu for DSS cell.

Kanu don dey DSS cell since 2021, afta dem bring am from Kenya.

Before she visit am, tori be say dem don dey deny Mrs Kanu make she no see her husband plenty times.

As she dey tok to IPOB members for radio for United Kingdom on Sunday, Uchechi thank Ubah say e help her visit her husband.

She tok say: “Make I use dis chance thank Senator Ifeanyi Ubah, wey move sharp-sharp help me visit my husband for DSS cell. I thank you, sir.”

“I thank oda Igbo politicians, governors, and dose wey dey hold political office wey dey worry about wetin my husband dey face.”

“Plenty of dese big pipo dey worry about how dem dey hold my husband unlawfully, and dem dey work without noise to arrange round table discussion make dem release am. I dey thankful to dem.”

Exit mobile version