Site icon PidginNews

Obasanjo Say Tinubu Never Find De Right Way To Handle Economy

Olusegun obasanjo

Former Presido Olusegun Obasanjo don yarn say de way wey Presido Bola Tinubu administration remove petrol subsidy dey necessary but dem do am “anyhow without correct tinking”.

Obasanjo tok dis one on Saturday wen im dey yan for one colloquium wey dem call ‘Nigeria Development: How To Waka Comot From Dis Economia Wahala and Insecurity Wey Dey Now’.

Im say de federal goment sef no implement de exchange rates unification well, na im make Naija people dey poor well well.

“Today, de goment don take three decisions, two of dem dey necessary but dem implement am anyhow and e don make de economy and Naija people poor. Dis na to remove subsidy, to close de gap between black market and official exchange rates and de third na to deal wit military coup for Niger Republic,” na wetin Obasanjo tok.

On top how to bring investors come Naija, de former presido say Tinubu goment “neva find de right way to handle de economy make investors get confidence and trust to begin dey enta Naija”.

Im say de goment no fit bring investors wen dose wey dey inside Naija dey comot and investors no dey take Naija serious.

Obasanjo say Total Energy choose Angola instead of Naija to put $6 billion dollars because “dem no see beta stable policy for Naija.”

“De way forward na production and productivity wey belief and trust for goment leadership go bring. No shortcut dey to develop economy, na only hard work and to sweat,” na wetin im tok.

“Economy no dey obey order, even sef military order. I sabi dat one. If we do am well, in two years, we go begin see light for front. E need make de leaders for all levels change dia style, do beta tin and get good mind to make investors trust dem wen dem get oda choices.

“Dem sabi us pass as we sabi ourselves. And now dem dey laff us, dem no dey take us serious. We gats show ourselves well make dem take us serious.

“If we change, investors go give us small chance, and if we handle security mata well-well for long-term, dem go begin test us small. Wit correct economic policies, beta mind and honesty, everytin suppose dey okay if everybody join hand and goment come be like helper for development, growth and progress.

“To dey play wit exchange rate no be de answer. De answer na to dey consistent and continue wit policies to make sure say tins dey stable and predictable.”

As part of de solution to Naija economia wahala, Obasanjo suggest 25-year social economic development agenda “wey go be like general agreement for de nation, by all political parties and dem go pass am into law for national assembly and state assemblies go also pass dia own for state houses of assembly”.

Im list some important tins wey suppose dey inside de agenda like education for everybody, food and beta chop through agribusiness, light for everybody, health for everybody, to dey produce tins for factory, and science, technology, innovation and artificial intelligence.

Exit mobile version