Site icon PidginNews

Passengers don dey stranded as Lagos airport dey closed because of NLC and TUC strike.

Lagos airport crowd

Plenti passengers don dey stranded sake of di strike wey di Nigerian Labour Congress (NLC) and Trade Union Congress (TUC) don declare.


Di domestic terminal for Murtala Muhammed International Airport don dey under lock and key, as all di enta-enta points no dey accessible.


Na sake of di industrial action wey NLC and TUC arrange na im make dem block evri wia pesin fit enta di airport.
Inside one video wey don dey circulate, passengers dey lament say dem no fit enta di airport at all.


Dis one don cause kasala and all di flights wey suppose comot from di airport don dey suspended.
Di reason wey make labour embark on dis strike na to push goment to increase di minimum wage of workers dem.
Labour dey propose N494,000 as di new minimum wage, but goment say na only N60,000 dem fit pay.


Leaders of di National Assembly and labour bin try hold one last-minute meeting yesterday to prevent di strike, but di meeting no yield any beta result.


Labour still insist say di strike must to start on Monday as dem don plan am.


Oga Festus Osifo, wey be di TUC President, say e no dey possible for dem as labour leaders to call off di strike without first to consult wit dia members.


“E go dey very difficult and even impossible for us as labour leaders to call off di strike here,” na wetin im yarn.

Exit mobile version