Site icon PidginNews

Plenty People Fit Don Die as Mosque Collapse for Lagos During Prayer Time

Mosque collapse in Lagos

Plenty People Fit Don Die as Mosque Collapse for Lagos During Prayer Time

Tori dey fly say one mosque don fall for Papa Ajao area of Lagos. De tin happen on Sunday wen dem dey pray afternoon prayer.

Photos and videos wey people dey social media show how de mosque don scatter for ground and how people for de area dey try help wit rescue work.

For statement wey Femi Oke-Osanyintolu, permanent secretary of Lagos Emergency Management Agency (LASEMA) release afta de incident, im say de agency reach de scene around 1:40pm.

Im say as dem do preliminary investigation, dem see say na one excavator wey dey clear road anyhow na im jam de mosque wey be storey building, come make de building collapse as prayer wan start.

“Dem rush four victims go hospital sharp sharp. Na total of 10 people na im dey trapped under de rubble,” de statement tok.

“Dem do Search and Rescue for de victims wey dey under de rubble wit supervision from de PS and wit help from de Agency heavy duty equipment like Crane, Hiab and excavator.

“Dem comot one adult wey don die while odas receive pre-hospital care for de scene from de Agency Pre Hospital Care Unit. Dem carry one pesin wey get serious injury go hospital.

“People wey dey for de scene of de incident na de Agency response team wey PS dey lead, LRU Fire unit, Lagos State Fire Service, LASPA, LASBCA, NEMA, Nigeria Police, LNSC, FRSC and LASAMBUS.”

Exit mobile version