Site icon PidginNews

Presido Tinubu Flag Off Lagos-Calabar Coastal Highway Wey Dey Cause Gbas-Gbos

Tinub Lagos-Calabar road

Presido Bola Tinubu don flag off de construction of de 700 kilometre Lagos-Calabar Coastal highway.

De ceremony happen for Victoria Island, Lagos, on Sunday.

Senate Presido Godswill Akpabio, Lagos govnor Babajide Sanwo-Olu, Imo govnor Hope Uzodinma, Ogun govnor Dapo Abiodun, and Minister of Work Dave Umahi follow Presido Tinubu go de event.

De construction of de highway start since March. Dem give de first phase of de project wey be 47.47 kilometres of dual carriageway to Hitech Construction Company Ltd.

De project don cause plenty gbas-gbos from how dem dey demolish structures for de beach and how people dey talk say dem no dey transparent for how dem take award de project and de cost.

On Thursday, during de 3rd stakeholders’ meeting, Umahi talk say federal goment go use de gazetted route wey dey some kilometres for de Lagos-Calabar coastal highway project to save submarine cables.

Exit mobile version