Site icon PidginNews

See How One Woman Beat Her 19-Year-Old Housegirl Sotay for Anambra

Victim

Tori don land say Anambra State Government don rescue one girl wey her madam dey beat anyhow for Ezinifite, Aguata Local Government Area of di state.

Di 19-year-old girl wey dem dey call Chidiebere Otenyi, wey come from Nkanu, Enugu state, bin chop serious beating from her madam, Mrs Martha Umenweke, wey accuse her say she thief N5000.

But Chidiebere deny di accuse, and na im make her madam vex come dey beat am anyhow.

Na one person wey see di bad tin wey dey happen na im carry di tori go give di Commissioner for Women Affairs and Social Welfare, Ify Obinabo, and na im dem come rescue di girl.

Victim2

Chidiebere wey still dey feel di pain for her body wen dem rescue her, talk say she don live wit Martha for one year and four months, and she dey chop serious punishment for small small tin, especially to dey starve her of food.

Wen dem ask Chidiebere more question, dem come find out say di 19-year-old still dey primary 3, and according to her, na her madam na im demote her for class wen she come her house.

Wen dem ask Mrs Martha Umenweke wey dey for her late sixties why she beat di girl like dat, she claim say Chidiebere thief her money, and na im make her beat am.

Victim 2

Dem still find out during di rescue say Martha get one person wey dey help her wey dem dey call Mr David, wey afta she don beat di girl, come help tie her hand and leg.

Dem don carry di case go give police make dem do more investigation and make dem carry am go Children, Sexual and Gender-Based Violence Magistrate court for Awka.

Exit mobile version