Site icon PidginNews

Tinubu don sign di bill wey go bring back di old national anthem.

Nigeria

Oga Godswill Akpabio, wey be di senate presido, tell everibodi for di joint sitting of di senate and house of representatives on Wednesday.

Akpabio say Presido Tinubu sign di bill into law on Wednesday morning.

Di senate presido also yarn say Tinubu go launch di old national anthem during anoda joint sitting of di national assembly today.

Di old national anthem na ‘Nigeria, We Hail Thee’. Di one wey dem dey use since 1978 na ‘Arise, O Compatriots’.

But Oga Tajudeen Abbas, wey be di speaker of di house of representatives, come talk say Tinubu no go give any “state of di nation” speech like dem bin first announce because today no be official Democracy Day.

Abbas beg evribodi sorry for di gbege wey happen before ontop dis mata.

For May 23, di house of representatives quick-quick pass di bill.

On Tuesday, di senate sef pass di bill during public hearing.

As Oga Tahir Monguno dey present im report for di bill, im talk say im panel no gree wit wetin Lateef Fagbemi, wey be di attorney-general of di federation (AGF), talk sey di process to change di anthem suppose pass through beta beta tins.

For di public hearing wey dem do for di bill, Fagbemi bin talk say dem no suppose rush di decision to change di kontri national anthem, but dem suppose use beta process take do am.

Exit mobile version