Site icon PidginNews

Billionaire Arthur Eze to Nigerians: Make una support Tinubu o, e no get boundary!

Arthur Eze

For inside one video wey don dey waka up and down social media, billionaire Arthur Eze don beg Nigerians make dem support President Bola Tinubu. E still praise di way Tinubu dey carry everybody along for im goment.

For di same video, dem even show as Eze donate N20m give one church.

E tok say, “Tinubu no get boundary at all. If you enta Abuja now, you go see Wike wey be Igbo man as minister. Umahi sef na Igbo man and e dey serve as minister. No boundaries at all. Na all di kain pipo we want be dat.”

Eze still add join say, “So dis Nigeria, afta eight years, e go change. E don already dey change sef. Now, I dey beg everybody make dem support am before we die.”

Dis no be di first time wey dis Igbo billionaire go dey praise Tinubu goment.

For October 2023, wen e dey tok for one Holy Mass to mark di 65th birthday of Rev Fr Patrick Alumuku for St Louis Catholic Church, EFAB Global Estate, Mbora, Abuja, Eze bin talk say di way Tinubu share di appointment of ministers and oda ogbonge posishons dey very fair.

“Di President don dey fair for di way e dey appoint pipo from di three major regions; di East, West, and North. Ndi Nigeria suppose support di President as e dey continue im beta agenda to change tins,” na so Eze tok.

Exit mobile version