Site icon PidginNews

Court don declare say di seat of pro-Wike lawmakers for Rivers State vacant

fubara wike

One High Court for Port Harcourt, Rivers State don give order say make Martin Amaewhule and 24 oda lawmakers no dey parade or hold demsef as members of di Rivers State House of Assembly again.

Di court, wey Justice C.N. Wali dey in charge, also give anoda order against Governor Siminalayi Fubara, di State Attorney General of Rivers State, and di Chief Judge of Rivers State, wey be di 26th to 28th people wey dem carry go court.

Dem say make dem no dey deal with, dey interface, or dey collect any resolution, bill, or oda tins from Amaewhule and di oda 24 people.

Justice Wali, wen e dey rule on top di case wey di Speaker of di Rivers State House of Assembly, Victor Oko-Jumbo, Sokari Goodboy and Orubienimigha Adolphus-Timothy carry go court, say make Amaewhule and di oda 24 people no dey sit for di auditorium of di House of Assembly quarters, or for any oda place to dey do any work wey concern di Rivers State House of Assembly.

Di court also declare say di seat of Amaewhule and di oda 24 people don empty until dem hear and determine di main case.

Dem adjourn di matter go 1st July 2024 to hear di motion.

Di wahala for di Rivers State House of Assembly don dey since 2023, wen kasala burst between Fubara and Nyesom Wike, wey be di minister of di federal capital territory (FCT).

For December 2023, 27 members of di House of Assembly comot from di Peoples Democratic Party (PDP) go join di All Progressives Congress (APC).

Di Rivers House of Assembly get 32 seats. One of di lawmakers, Dinebari Loolo, die for September 2023.

For October 2023, Ehie Edison become di speaker of di factional House of Assembly, afta dem remove am as house leader by di members wey dey support Amaewhule – wen dem dey plan to remove Fubara.

Edison later resign as lawmaker to become chief of staff to di governor.

Di lawmakers wey dey support Amaewhule na Wike boys.

Recently, Jumbo, wey be di lawmaker wey dey represent Bonny constituency, come become di factional speaker.

Exit mobile version