Site icon PidginNews

Peter Obi Hold Secret Meeting With Atiku And Sule Lamido For Abuja

Peter Obi and Atiku Abubakar

Peter Obi, wey be di presidential candidate of Labour Party (LP) for di 2023 elections, don meet with former Vice-President Atiku Abubakar for Abuja on Monday.

Na Atiku imsef, wey be di presidential candidate of Peoples Democratic Party (PDP) for di 2023 elections, announce di tori for im official X handle.

“Na my honour and privilege to host @PeterObi today. -AA,” na wetin Atiku write.

Dis na di first time wey di two politicians dey meet since di general elections end last year.

No be only Atiku, Peter Obi still visit Sule Lamido, wey be former governor of Jigawa, for im house for Abuja.

Lamido na di governor of Jigawa from 2007 to 2015.

We no sabi wetin dem discuss for di meeting sha.

E be like say Peter Obi dey try build bridge with oda politicians dem afta di election. Make we dey wait dey see wetin go comot from all dis one.

Exit mobile version