Site icon PidginNews

Peter Obi Tok Say Na ‘Establishment Of Criminality’ No Allow INEC Server Work

Peter Obi

Peter Obi wey be di former presidential candidate of Labour Party (LP), don yarn say na di ‘establishment of criminality’ make di Independent National Electoral Commission (INEC) servers no work during di last presidential election.

Obi wey still dey insist say di pipo must one day make am work, explain say Amazon don already testify say dem no record any glitch for dia system dat day wen di presidential election happen.

Di former govnor of Anambra State tok dis one on Friday wen e dey Canada dey address di mata about di last general election, including di IREV servers.

Obi bin dey Canada for “thank you” tour to appreciate Nigerians wey dey live for di kontri sake of di support wey dem give am during di 2023 campaign/ general elections.

E say: “Where we come get am wrong for di last election? We no get am wrong for anywhere. We do di right tin dem. But as I dey always tell pipo: wen you wan bring change, you go fight all dose pipo wey dey live on top di old order. Dem no dey go away; dem go gada demsef togeda. And no tink say to comot establishment na straight race. Na long-distance journey for anywhere for di world. Go check am anywhere, weda you dey look wetin happen for India, wit Mandela for South Africa, or America. No change don happen overnight, e dey take time. I dey beg all of una, if una really want change, we just begin so. We go just continue from where we dey.

“Yes, e fit get one or two tins wey we go correct, dose tins we go correct dem. I dey assure una say we dey correct dem without to dey mention dia name. E no go dey easy.

“Di INEC server na di same tin wit di establishment. Di server no go work because na di establishment make am be like dat make e for no work. Na our own to continue to dey tok say e go work. But glitch no dey. Amazon come tok say glitch no dey. Wen Amazon get glitch, dem dey notice am globally – dem dey record am globally. And dat period, we bring Amazon pesin come wey say dis na di number of glitches wey we don get since wen we start. And dem no report any one dat day. We sabi say e no happen. Na di glitch of di establishment criminality wey dey di system. And we must one day make am work.”

Exit mobile version