Site icon PidginNews

Shehu Sani Say Make Dem Invite El-Rufai To Explain How E Take Spend Kaduna Money For 8 Years

Shehu Sani

Sani Shehu say make dem invite El-Rufai to explain how e take spend Kaduna money for eight years

Sani Shehu wey bin dey represent Kaduna North Central for Senate before don yarn say to recover de $350 million World Bank loan wey dem tiff no go dey possible if na only former Commissioners and Advisers dem dey ask.

E say dem must invite former Govnor Nasir El-Rufai sef make e come explain about de loan mata.

Few months wey don pass, Govnor Uba Sani of Kaduna State bin dey worry say e inherit big debt of $587 million, N85 billion, and 115 contract palava from de former govment wey be El-Rufai own. Dis one don make am hard for am to pay workers dem salary sharp sharp.

As e be so, Kaduna State House of Assembly don promise to torchlight wetin happen for El-Rufai time as govnor.

But Sani Shehu wey be former Senator post for im Facebook page on Friday say dem no suppose leave El-Rufai make e no explain imsef. E say make dem call El-Rufai make e talk about Kaduna share of Paris refund, Excess Crude funds, Stamp Duties Funds, Ecological Funds, and de plenty loan wey dem collect from Central Bank and oda local banks.

Sani Shehu come add join say, “All dose contractors and yeye consultants wey run with money, and all dose people wey chop from how dem take misuse Kaduna State property and still dey enjoy demsef, make dem thank dia star say no be Comrade Shehu Sani dey govern de state now.”

Exit mobile version