Site icon PidginNews

Dem Rape One-Year-Old Pikin For Day Care For South Africa

South Africa School Rape

One family, community and groups don dey call for justice afta one pikin wey neva even reach two years chop rape for one creche for Newlands East for Durban, South Africa.

Dem say di tin happen for May 6, 2024, wen dem carry oda pikin dem go swimming lesson, come leave di small pikin behind because she still dey wear pampers.

Wen di mama cari di pikin go give di creche oga, di oga tell am say na only she, her husband and two oda small pikin dem dey di place.

Wen dem cari di pikin comot from di creche, she cry well well. As di mama check her pikin for house, she come see say her private part don swell and e red. Di mama cari di pikin go hospital but dem send am back.

Wen she go anoda doctor di next day, di doctor see say true true dem don abuse di pikin but e no get rape kit.

Afta two days, one surgeon come confam say true true penis don enta di pikin and dem open case against di suspect, wey be di oga of di creche husband.

Afta di mama post for social media about wetin happen, oda tori come out say di suspect don rape anoda girl for di same place before.

Newlands East police dey torchlight di mata.

For di oda hand, di grandmama of di pikin wey no wan make dem call her name so dat dem no go know di pikin, share wetin happen.

She talk say, “For May 6, my pikin drop di baby for creche by 8am. As she dey hand ova di pikin to di creche oga, di oga tell am say na only two pikin dem dey dia – di one year 11 months pikin (wey be my grand pikin) and anoda baby – plus hersef and her husband, as oda pikin dem wey no dey wear pampers don go swimming lesson.”

“Around 5:45pm to 6pm, my pikin call say make my patna go pick di baby for creche. As my patna reach dia, di baby dey cry. Wen di baby reach house, she still dey cry. My pikin come back like 10 minutes later, di baby still dey cry dey pull her pampers dey show her mama say her cookie (vagina) dey pain am.”

“We no send am first as we tink say na pee dey pain am. She cry tey well well. We cari am go King George Hospital for night but di doctor say na just infection, if e still dey pain afta two weeks, make we come back. I no happy with wetin dem talk because I no even get money to buy di medicine dem write.”

“Di next day (May 7), we go Newlands East Medical Centre. As we see di doctor, she say dem don touch di baby.

“She send us go Addington Hospital. For dia, di doctor no even get rape kit. For Wednesday, May 8, we go back to di first doctor, ask am wia we go go because we no dey see beta result afta all di waka wey we don waka.

Dat Wednesday, dem go Newlands East police station and one warrant officer call dem. She say di officer yan wit her pikin say she wan arrest am sake of some tins wey dem post for social media, and di creche oga don report.

“Di officer still talk say dem neva open any case sef. She even say she go cari di pikin go social care. We explain give am say na up and down we don dey go hospital dey find rape kit. We even show am di letter from di doctor. I show am di video and pictures dem,” na so di grandmama tok.

As dem show di warrant officer di foto and video dem, she come see say somtin no dey okay and she tell dem make dem go Thuthuzela Care Centre.

“Na early mor-mor for Thursday na im surgeon come confam say true true na penis enter di pikin. Later dat evening, we go open case for Newlands East police station.

“For Friday, one oga from Family Crisis Services wey dey torchlight di mata come ask us questions. For Monday, e tell us say dem still dey work on top di mata.”

Dr Nadia Bernon wey be Rapid Response Team Leader on top Gender-Based Violence and Femicide – Newlands East (ward 11), raise di mata say di creche dey only collect small small girl pikin dem and say dem must don reach 5 years.

“Dem no dey collect boy pikin. As activists for di community, we no know before say di oga husband get tori of sexual offence and rape case for im head. As di woman sabi say her husband get dat kain tori, why she go come open creche come still leave small pikin for her husband hand? By 8pm on Thursday, di creche oga serve me harassment paper as I dey yan wit di grandmama for phone.”

Bernon come ask if dem fit arrest di creche oga and di pesin wey dem suspect, and if dem fit lock di creche.

KwaZulu-Natal police tok-tok pesin, Colonel Robert Netshiunda, say Newlands East police dey dig dis mata of rape wey dem report so.

Exit mobile version