Site icon PidginNews

Wicked Man Wey Get 5 Girls Cut Im Pregnant Wife Belle Open To Check If Pikin Na Boy Or Girl

Panna Lal

One 46-year-old man for India don chop life imprisonment afta im use cutlass take cut im wife wey dey 8 months pregnant for belle to check if na boy or girl she wan born.

Panna Lal, wey dey live for Badaun Civil Lines for Uttar Pradesh, bin attack im wife, Anita Devi, for September 2020.

De couple don marry for 25 years and dem born five girls.

But dem dey always fight sake of say Panna Lal wan make Anita born boy.

Anita family sabi de wahala wey dey between dem and dem try to beg Panna Lal make im stop to dey fight but im threaten say im go divorce Anita go marry anoda woman wey go born boy for am.

De day wey de tin happen, de couple fight again ontop de gender of de pikin wey dey Anita belle.

Panna Lal vex well-well come threaten say im go cut Anita belle open to check if na boy or girl she carry.

Wen Anita try to fight back, im threaten say im go kill her.

Im attack her wit cutlass come make Anita try run but im grab her come use de cutlass cut her belle open.

Anita tell court say de cut deep well-well sotay her intestine come dey hang from her belle.

She run comot for street and her broda wey dey work for shop wey dey near dia house hear as she dey shout come rescue her. As Panna Lal see am, im run comot.

Dem rush Anita go hospital. Even though she survive de attack, her pikin wey be boy no make am.

De fast track court of Additional District and Sessions Judge Saurabh Saxena sentence Panna Lai on Thursday, May 23, 2024.

For court, Panna Lal argue say na Anita injure herself to lie against am sake of say im and Anita broda dey drag property.

Anita broda, Ravi Singh tell Times of India say wen im sister dey pregnant for de sixth time, Panna wan make she remove de pikin sake of say one village priest convince am say na anoda girl she get for belle.

“But Anita no gree, she wan keep de pikin. Panna dey always beat Anita but we no tink say im go do dis kain extreme tin. We dey happy say im don chop dis punishment, but e dey sad say my sister neva dey live normal life,” na wetin im tok.

Exit mobile version