Site icon PidginNews

Wahala for Wofai Fada Marriage As In-Laws Reject Am

Wofai Fada

Wetin suppose be better love story for Nollywood actress and comedian, Wofai Ewu, wey pipo sabi as Wofai Fada, don turn to anoda tin as her marriage to Taiwo Olakitan Cole don enter family wahala.

Everytin start afta di comedian announce her engagement to Taiwo for her Instagram page on Saturday, May 4, 2023.

Without any caption, Wofai share photos of herself and her boo, dey show ring for her wedding finger, dey show say wedding dey come.

As e dey normal, pipo begin congratulate her, her fans, colleagues and pipo wey like her come enta di post comment section to show how dem happy for di mata.

Small time afta, videos from di couple traditional wedding wey happen for Wofai village for Ugep, Cross River State, begin spread for social media.

But dis one come bring unexpected twist for di love story as di in-law family release statement to deny di union between dia son and di actress.

Di statement wey Engr Kunle Cole sign on behalf of di Cole family, tell evribody say di family no know about di traditional wedding and dem no give permission sef.

Di in-laws warn say make di couple no dey parade demsef as members of di Cole family as dem no know dem or accept dem.

“Images and videos don come our side wey show our son Taiwo dey marry one Wofai Ewa for traditional ceremony for Ugep, Cross River State.”

“Dis one na to tell all our pipo, family and friends say di Cole family of Victoria Island Lagos no know about any marriage ceremony of our Son Taiwo Olakitan Cole, we no give permission or support for dis mata.”

“As e be so, pesin or pipo wey dey parade demsef as new members of di Cole family sake of dis purported event, we no know dem and we no accept dem. Make evribodi disregard all publications and documents wey dey circulate about dis tin,” na so di Coles tok.

For one phone call wey dem say na between Taiwo papa and im friend, di ‘father-in-law’ explain wetin happen wey lead to di traditional wedding.

E still express di family concern about di age difference between Wofai and Taiwo, say Wofai na 38 years old, while Taiwo na 30.

Exit mobile version