Site icon PidginNews

X (wey be Twitter before) don officially allow Adult content for di platform.

X twitter

Elon Musk’s X (wey be Twitter before) don update dia rules to officially allow adult and graphic content for di platform.

Adult content and nudity don dey Twitter for years and – unlike Facebook or Instagram – dem no ban am even before Musk buy di company for late 2022.

Di new guidelines, wey Tech Crunch first report on Monday, say users fit share adult content “as long as na consensual production and distribution of adult nudity or sexual behavior.”

X update di guidelines over di weekend, dey talk say “sexual expression, weda na visual or written, fit be legit form of artistic expression.”

Under di new policy, e dey okay to post adult content as long as dem label am and no dey show am for prominent places like profile pictures or account banners.

Accounts wey dey always post adult content go need to automatically mark dia image and video posts as sensitive content.

Dem go also ban adult content for users wey be children or adult users wey no wan see am.

Di policy also include AI-generated content, animations, cartoons, hentai and anime.

X’s safety team tweet say di new guidelines go “bring more clarity to our rules and transparency into how we dey enforce for dese areas.”

Since Musk buy Twitter for 2022 wit di plan to promote free speech, pipo don criticize am say e cut di content moderation teams.

Under im ownership, di platform don also get technical issues and don bring back accounts of right-wing conspiracy theorists and former US President Donald Trump.

Musk also wan make X get more ways to make money beyond advertising and turn am into “super app” like China’s WeChat, wey get messaging, voice and video calling, social media, mobile payments and online booking services.

Exit mobile version