Skip to content

EFCC Don Warn All Oyinbo Embassy For Naija Make Dem No Dey Collect Dollars

EFCC

De Economic and Financial Crime Commission (EFCC) don tell all de oyinbo embassy wey dey for Naija make dem no dey do transaction for foreign money again, say make dem dey use Naira money.

EFCC still yarn say make Naija embassy wey dey for oyinbo country sef dey collect Naira for dia own business.

Dem talk say dem wan make sure say Naira money no fall sef-sef and make oyinbo money no dey control Naija economy.

For letter wey EFCC write give Oga Yusuf Tuggar wey be Minista of Foreign Affairs for April 5, 2024, dem say dem no too happy wit how some oyinbo embassy dey bill Naija people and oda oyinbo people for dollas.

EFCC come talk say wetin dey for Section 20(1) of Central Bank of Nigeria Act, 2007 na say na only Naira be legal money for Naija.

De letter say, “Any transaction wey use money wey no be Naira for anywhere for Naija, e dey against de law and e no good at all.”

EFCC still yarn say as some embassy no wan collect Naira for dia work and dem dey fix dia own exchange rate, e no only dey against de law but e be like say dem dey take Naija play wey be sovereign kontri wit im own currency.

Dem say dis kain tin dey spoil Naija money policy and how de kontri wan better for economy.

EFCC say dem no go gree dis kain tin again, especially as tins dey tough for economy now and different people dey try spoil Naija policies.

Meanwhile, EFCC don begin raid again to make sure say Naira dey stable.

EFCC people bin don catch some Bureau De Change people for Wuse Zone 4 market for Abuja on Tuesday.

But some traders still talk say some BDC people no gree make dem catch dem wen EFCC people come.

De EFCC people bin wan clean de market of people wey dey sell for street and stop anyhow trading.

But some people no gree on Tuesday and dem shoot gun and spoil EFCC motor dem.

De oda week, EFCC bin don catch ova 35 people wey dem suspect say dem dey play game wit foreign exchange mata.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Pidgin Editorial Team

Pidgin Editorial Team

Di Pidgin Editorial team na one group of journalists and writers wey get passion to dey make news available to people for Pidgin English. Dis one na for dose of us wey grow up wit pidgin, we love pidgin well-well and we go love to dey follow wetin dey happen for news using pidgin. We dey here for una.