Skip to content

Price Of Gas Don Go Up Well Well For Naija

cooking gas nigeria

De average price to fill 12.5-kilogram cylinder for cooking gas don increase well-well by 55.22 per cent reach N15,929.04 for March dis year compared to N10,262.56 for de same month last year.

Na wetin National Bureau of Statistics (NBS) talk for dia latest March Cooking Gas Price Watch.

Wen you compare am wit last month, de price of cooking gas increase by 5.77 per cent reach N15,929.04 for March 2024 from N15,060.38 wey e be for February.

As e be say dem check am state by state, na Sokoto get de highest average price to fill 12.5kg cylinder of cooking gas wit N17,833.33, followed by Osun wey get N17,588.46 and Anambra wey get N17,417.65.

For de oda side, na Katsina get de lowest average price of N12,400.00, followed by Kebbi and Bauchi wey get N13,137.50 and N14,484.25.

Wen dem check am by zone, de South-South get de highest average price to fill 12.5kg cylinder of cooking gas wit N16,859.85, followed by de South-East wey get N16,734.87. But na de North-East get de lowest price of N14,943.48.

Dis one dey happen as tins cost don dey increase well-well for Naija.

NBS don plan to release April inflation report next week.

Before dis one, de kontri headline and food inflation bin don increase reach 33.20 per cent and 40.01 per cent for March 2024.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Pidgin Editorial Team

Pidgin Editorial Team

Di Pidgin Editorial team na one group of journalists and writers wey get passion to dey make news available to people for Pidgin English. Dis one na for dose of us wey grow up wit pidgin, we love pidgin well-well and we go love to dey follow wetin dey happen for news using pidgin. We dey here for una.