Skip to content

Lead British School Student Wey Dem Bully Drag School Go Court For N500m Damages

Namtira Bwala

Di female student of Lead British International School, Gwarimpa, Abuja, wey anoda student bin bully don carry di school go Federal Capital Territory (FCT) High Court.

Ms. Namtira Bwala dey sue di school say dem no protect her from di bullies and dem still try cover up di mata.

Na one female student wey dem dey call Mariam Hassan bin dey slap Namtira many times and di video cause gbege for social media.

Afta di tin happen, di school authorities come outside say dem dey torchlight di mata and dem dey do everytin to solve am. Even di Federal Goment through di Ministry of Women Affairs and Social Development put mouth for di mata.

Di bully, Maryam later apologize to di victim and di public inside one video message wey spread well-well.

But e be like say Namitra Bwala wey be small pikin no dey satisfied. She and her guardian, Oga Daniel Madu Bwala don waka go FCT High Court dey find justice. Dem dey accuse Lead British International School say dem no do dia work and dem try hide wetin happen.

According to di court papers, Namitra dey find total of N505m damages from Lead British International School, Gwarimpa, Abuja. She say di school no provide better place for her to dey learn wen she dey under dia care.

Di money wey she dey find na N500m damage because di school no protect and care for her, N5million for di cost of di case, and make dem apologize for two national newspapers.

E be like say dis school go hear am if dem no handle dis mata well.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Pidgin Editorial Team

Pidgin Editorial Team

Di Pidgin Editorial team na one group of journalists and writers wey get passion to dey make news available to people for Pidgin English. Dis one na for dose of us wey grow up wit pidgin, we love pidgin well-well and we go love to dey follow wetin dey happen for news using pidgin. We dey here for una.