Skip to content

Tinubu Don Ban Buying Of Cars Wey Dey Use Petrol

Bola Ahmed Tinubu

Tinubu don ban gov’t officials from dey buy petrol cars.

President Bola Tinubu don put mouth for di matter say make members of di Federal Executive Council, FEC, no dey buy cars wey dey use petrol again.

Di Presido don also give order say all di gov’t ministries, departments, and agencies must to dey buy cars wey dey use compressed-natural-gas (CNG) instead of petrol.

Na im Special Adviser on top Media and Publicity matter, Chief Ajuri Ngelale, yarn dis one for statement wey im release on Monday evening, May 13, 2024.

According to wetin im tok, dis directive dey follow Tinubu im commitment to make sure say di kontri get better energy security, drive utility, and reduce di high cost of fuel.

Im still yan say di President directive dey also to make Nigeria dey move go front for di effort to change go cleaner energy, as dem don already agree say cars wey dey use CNG dey produce lower emissions, and e still dey cheaper for Naija pipo wey dey use am.

As Presido dey address di members of di Federal Executive Council (FEC) for State House on Monday, im tok say no be to dey waka for same spot di kontri go take move forward. Im say dem get di mind to push di implementation of CNG adoption for di whole kontri, and say na dem as gov’t officials suppose show example to lead di way to dat better future wey dem dey work to achieve for di pipo. Na from dem e go start, and wen pipo see say dem serious, Nigerians go follow dia lead.

Di Presido still give order say make dem reject all di memos wey FEC members bring come wey dey seek to buy di normal petrol cars, and im task di affected members make dem go back go find procurements wey get value and wey dey use CNG.

Di statement still add join say di Presido still dey committed to use di kontri gas potential well, to reduce di high cost of transportation for di masses and to make di standard of living better for all Nigerians.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Pidgin Editorial Team

Pidgin Editorial Team

Di Pidgin Editorial team na one group of journalists and writers wey get passion to dey make news available to people for Pidgin English. Dis one na for dose of us wey grow up wit pidgin, we love pidgin well-well and we go love to dey follow wetin dey happen for news using pidgin. We dey here for una.