Skip to content

Pathologist Tell Court Say Dem No Fit Know Wetin Kill Mohbad

Mohbad

Di pathologist wey dem hire to torchlight wetin kill late singer Ilerioluwa Aloba wey dem dey call Mohbad don tell di coroner inquest say dem no fit know wetin kill di late singer.

Senior Advocate of Nigeria, Wahab Shittu, wey dey court today May 15 for di inquest tell tori people say di pathologist talk for court say by di time dem do di test, Mohbad body don already spoil.

As e dey yarn with tori people afta di sitting, Wahab talk say:

”According to am, dem no fit know wetin kill am. E give plenti reasons. E say by di time dem do di test, di body don spoil and e no dey possible for dem to know wetin kill am. So wetin e dey talk be say dem no fit know wetin kill am and wen you say dem no fit know wetin kill pesin, e mean say e dey suspicious, e no dey clear, no particular reason. E still talk join say e fit be sake of how im take react to some kind drugs wey dem give am before e die. Again, e come add join say e no know weda na dose drugs na im actually kill am.”

Wahab still talk say one witness still talk for court about how di late singer bin get kasala with im wife, Wunmi, and Sam Larry.

Make we remember say di 27-year-old singer die for some kain way wey dey make pesin wonder on September 12, 2023. Dem bury am di next day for Ikorodu. But dem come comot im body on September 21 make dem for do autopsy on am to know wetin kill am.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Pidgin Editorial Team

Pidgin Editorial Team

Di Pidgin Editorial team na one group of journalists and writers wey get passion to dey make news available to people for Pidgin English. Dis one na for dose of us wey grow up wit pidgin, we love pidgin well-well and we go love to dey follow wetin dey happen for news using pidgin. We dey here for una.