Skip to content

Senator Ali Ndume Tok Say Make Dem No Kill Politicians Wey Thief Billions

Ali Ndume

Senator Ali Ndume, wey be di Chief Whip for Senate, don talk say im no go support death penalty for corrupt politicians wey thief millions or billions but na only for dose ones wey thief trillions.

Ndume point out say na individuals dey influence corruption for Nigerian politics pass.

Im suggest say e fit be say e no go need serious punishment like dat.

Di senator agree say politicians dey do corruption but dem dey still share di money to di people.

Im tok say, “If you compare us, politicians, to all di corruption, na small tin e be. Our own corruption na people-driven,” na wetin im tell Channels Television.

“If you thief am, you go share am give people. If you no do am, you no go come back afta four years. No reason dey to thief.

“I don dey National Assembly before, I no fit say because say we dey TV now I no go talk true.

“If dem wan put death penalty for corruption, I go support am but you no go just kill person wey thief one million or one billion, no be so. But person wey thief one trillion of goment money, dem suppose kill am.”

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Pidgin Editorial Team

Pidgin Editorial Team

Di Pidgin Editorial team na one group of journalists and writers wey get passion to dey make news available to people for Pidgin English. Dis one na for dose of us wey grow up wit pidgin, we love pidgin well-well and we go love to dey follow wetin dey happen for news using pidgin. We dey here for una.