Skip to content

Ooni of Ife Tell Im Daughter Say Make She Go Bring Husband Come As She Don Turn 30

Ooni of Ife and duaghter.jpeg

De Ooni of Ife, Oba Adeyeye Ogunwusi Ojaja II don go social media to celebrate im daughter, Adeola, wey turn 30 today May 20.

For im post, de ogbonge king pray say make God dey with im daughter and e no stop there, e still ask her say make she go bring man come house for marriage.

Na wetin im write be dis;

”Princess Adeola, Aanuoluwapo, Atutunini, Bamdefe Ogunwusi, Omo Ojaja II. I dey really happy for de better life wey you don live. Make God Almighty continue to dey with you for everytin wey you dey do. Amen!

Wen you turn 10, your papa go dey talk to you about school and your future. For 20, e encourage you say make you dey listen and understand say moral and well-being dey important, even as you dey find your independence.

Now wey you don turn 30, you don be big woman. Your papa know say you no wan make im dey advise you again because you don finally get your independence.

I talk 10 to you and you show small independence behaviour, I talk 20 to you and you still show de independence behaviour wey dey clear. Now I dey talk 30 to big woman, so go bring husband come give daddy o…

With love from de throne of Oduduwa.

Congratulations, and make God continue to guide you for everytin wey you dey do.”

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Pidgin Editorial Team

Pidgin Editorial Team

Di Pidgin Editorial team na one group of journalists and writers wey get passion to dey make news available to people for Pidgin English. Dis one na for dose of us wey grow up wit pidgin, we love pidgin well-well and we go love to dey follow wetin dey happen for news using pidgin. We dey here for una.