Skip to content

Black Market Dollar To Naira Exchange Rate Today 27th May 2024

Naira to Dollar exchange rate

See di black market Dollar to Naira exchange rate for today 27th May, below. You fit swap your dollar for Naira with dis rates dem.

Dollar to Naira Black Market Exchange Rate Today

Buying RateSelling Rate
N1515N1520

According to tori from Bureau De Change (BDC), di exchange rate for one dollar to naira for Parallel Market, wey some dey call Black Market, na N1515 if you wan buy and N1520 if you dey sell today Monday 27th May 2024.

Abeg make una note say Central Bank of Nigeria (CBN) no dey recognize di parallel market. Dem don tell everybodi wey wan do Forex business to go meet dia own bank.

Dollar to Naira CBN Rate Today

Buying RateSelling Rate
N1481N1482

But you know say for Naija, black market still dey important well-well, even if CBN no gree. Plenti pipo still dey run go der to change dia money.

So, if you get dollar wey you wan turn to naira, or you get naira wey you wan turn to dollar, dis na di rate wey dey ground for black market today.

But you know say dis rates dey fit change anytime, so make you no just jump enta am like dat. Beta tin na to confam di current rate before you begin do any business for der.

As we dey always tok, make una dey careful as una dey do una transactions for black market, so dat una no go enter any yawa. If you get any doubt at all at all, to go meet your bank na di best tin.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Pidgin Editorial Team

Pidgin Editorial Team

Di Pidgin Editorial team na one group of journalists and writers wey get passion to dey make news available to people for Pidgin English. Dis one na for dose of us wey grow up wit pidgin, we love pidgin well-well and we go love to dey follow wetin dey happen for news using pidgin. We dey here for una.