Skip to content

Abia goment put N25 million bounty on top pipo wey kill soldiers

Alex Otti

Tori be say, Abia state goment don promise to pay N25 million to anybodi wey go fit give dem informate wey go lead to arrest of di pipo wey kill five soldiers for di state.

E be like say na suspected members of di proscribed Indigenous People of Biafra (IPOB) na im kill di five soldiers of di Nigerian Army on May 30, as dem bin dey try to enforce sit-at-home for Obikabia junction for Aba.

Before den, IPOB bin don give order say make evribodi sidon for house on May 30 to take remember Biafra Day.

On Friday, di army come out tok say dem go revenge di killing of dia soldiers.

For statement wey dem release on Friday, Okey Kanu, wey be di commissioner for informate for Abia, condemn di attack on top di soldiers by di pipo wey dem suspect say na separatists.

“Abia state goment dey see wetin happen on Thursday, May 30, 2024, as serious wahala wey criminal pipo dey cause, as dem wan make Abia go back to di days wen tins bin dey scatter and pipo dey fear, especially for Aba, wey be di main place wey money dey enter for di state,” na so di statement tok.

Dem still tok say e dey pain dem well well say dis kin tin dey happen afta all di moni wey dem don spend for di last one year to fix tins for di city and make am beta place wey go attract businesses from inside and outside di kontri.

To show say dem mean business, di state goment say dem dey offer N25 million to anybodi wey go give dem better informate wey fit help dem find and arrest any of di criminals wey join hand for di killing and di wahala wey e cause for Aba and di area dem.

Dem don tell all di security pipo for di state to dey treat pipo wey bring informate with secrecy, so dat dem go fit trust dem well well and help dem find di criminals.

Abia state goment still promise to support di families of di soldiers wey die, as dem go dey pay dia wives small moni every time and dem go still train dia pikin dem go university. Copy

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Pidgin Editorial Team

Pidgin Editorial Team

Di Pidgin Editorial team na one group of journalists and writers wey get passion to dey make news available to people for Pidgin English. Dis one na for dose of us wey grow up wit pidgin, we love pidgin well-well and we go love to dey follow wetin dey happen for news using pidgin. We dey here for una.