Skip to content

Labour and FG don finally gree (VIDEO)

nigeria labour congress

Di national tripartite committee on minimum wage go dey meet every day for one week, according to wetin di Secretary to di Government of di Federation, George Akume, talk afta dem finish meeting wit Organized Labour on Monday night.

Di meeting wey start by 5:00 pm end around 11:00 pm.

Organized Labour and di government also sign agreement.

Even though dem neva let pipo know wetin dey inside di agreement, Akume talk for di end of di meeting say President Bola Tinubu administration dey committed to pay pass N60,000 as minimum wage, no worker go suffer because of di strike, and di tripartite committee go dey meet every day for di next one week.

Di Nigeria Labour Congress (NLC) and Trade Union Congress (TUC) go gather on Tuesday to yarn wit dia members and decide wetin dem go do about di nationwide strike wey still dey go on.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Pidgin Editorial Team

Pidgin Editorial Team

Di Pidgin Editorial team na one group of journalists and writers wey get passion to dey make news available to people for Pidgin English. Dis one na for dose of us wey grow up wit pidgin, we love pidgin well-well and we go love to dey follow wetin dey happen for news using pidgin. We dey here for una.