Skip to content

TCN Yarn Say Substation Go Dey Darkness For 2 Weeks

electricity nigeria

Di Transmission Company of Nigeria (TCN) don announce for Benin on Saturday say dia Amukpe substation no go get light for two weeks.

Na wetin dey for di statement wey di General Manager for Public Affairs TCN, Ndidi Mbah, sign.

Madam Mbah tok say di light go comot from May 4 go reach May 17.

According to TCN, di reason for di darkness na to allow contractors get safe environment to erect two 132KV transmission tower for di substation.

Di company still yarn say sake of dis power outage wey dey come, Benin DisCo no go get bulk power supply through di Adeje industrial, woodland, Mosogar, Sapele and Abraka feeders for dat period.

“Di Transmission Company of Nigeria (TCN) dey hereby state say dem go start to dey erect two 132kV transmission towers for dia Amukpe Transmission Substation.”

“And dem go still restring one portion of di Benin-Delta and Delta-Oghara 132kV double circuit transmission lines from Saturday, May 4 go reach May 17, 2024.”

“Sake of dis one, Amukpe Substation no go get light for di duration of di work.”

“Also, Benin DisCo no go get bulk power supply through dis feeders: di Adeje, Industrial Woodland, Mosogar, Sapele and Abraka feeders.”

“Di outage dey necessary to create safe working environment for di contractor. Wen dem complete di project, e go put N-1 redundancy wey go allow TCN supply bulk electricity to di substation from either di Benin or Ughelli transmission line.”

“Dis one mean say wen one transmission line get fault, di substation still fit receive bulk electricity from di second line,” na wetin Madam Mbah tok.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Pidgin Editorial Team

Pidgin Editorial Team

Di Pidgin Editorial team na one group of journalists and writers wey get passion to dey make news available to people for Pidgin English. Dis one na for dose of us wey grow up wit pidgin, we love pidgin well-well and we go love to dey follow wetin dey happen for news using pidgin. We dey here for una.