Site icon PidginNews

Nasboi Say E Bin Tink Say Sydney Talker Na Yahoo Boy Before

Nasboi

One popular skit maker and musician wey dem dey call Nasboi don open up on top how skit making and social media influencing dey bring plenti money.

E tok say sake of say di creative industry dey bring plenti money, e bin dey tink say popular skit makers like Sydney Talker dey do Yahoo Yahoo until e join di industry himself.

Wen e dey yan for di Bahd And Boujee Podcast wey reality star Tolanibaj and actress Moet Abebe dey host, Nasboi talk say plenti pipo still dey accuse skit makers and influencers say dem be Yahoo boys because dem no sabi how di creative industry dey rake in money.

E say: “Before I turn skit maker, I fit beat my chest say Sydney na Yahoo boy. Because I no sabi how dis skit making and influencing dey bring money until I join di industry.

“Plenti female influencers and skit makers sef dey collect trolling. Social media users dey always yarn say dem dey sleep wit men collect money but dem no know say dis female influencers dey make ogbonge money from endorsements and adverts.

“Yahoo dey stress pesin. E no even dey bring money like skit making. Some skit makers wey pipo no sabi dey still make plenti money. I know one person wey make $33,000 from just one video for Facebook. Pipo no even sabi am like dat.”

Exit mobile version