Skip to content

CBN Govnor say na pastor start di first Islamic Bank for Nigeria

Olayemi Cardoso

Oga Govnor of Central Bank of Nigeria (CBN), Olayemi Cardoso don tok say na one assistant pastor na im first begin di mata of Islamic Banks for Nigeria.

Cardoso yarn dis one for one party wey dem do for Abuja to holla at Dr Umar Oseni, wey be di Oga Kpatakpata for Organisation of Islamic Cooperation Arbitration Centre. According to wetin Cardoso tok, e don clear for Naija people eye now say di reason why dem bring Islamic banks come Nigeria no be to turn di kontri to Muslim kontri, but na to helep small and medium businesses dem.

Cardoso, wey im representative be di CBN Director of Legal Services, Kofo Salam-Alada, still tok say dem dey consider to approve more banks wey dey follow Shariah law sake of di plenty benefits wey e don bring give di citizens dem. Im still tok say Islamic banks like Jaiz, Tajj, and Alternate Bank don show say dem fit stand strong since wen dem start dem.

“Some years wey don pass, Central Bank of Nigeria begin one journey to bring Islamic Banking and Financing come Nigeria. E happen wen dem appoint one young man as govnor of CBN. But plenti people no sabi say di first pesin wey start dis journey na pastor of church. Dat time wen di journey start, im still dey work as pastor part-time. So e no be attempt to turn Nigeria to Muslim kontri or to make dia financing be like Muslim own. Wen Prince (Emir Sanusi) come, im kontinu di journey,” na so Cardoso tok.

Make we remember say na for Chukwuma Soludo time as CBN govnor na im dem establish di first Islamic Bank for Nigeria, wey be Jaiz. As e be so, Nigeria get four Islamic banks out of di 43 Deposit Money Banks wey dey di kontri, according to di list of approved banks for Nigeria wey CBN just update.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Pidgin Editorial Team

Pidgin Editorial Team

Di Pidgin Editorial team na one group of journalists and writers wey get passion to dey make news available to people for Pidgin English. Dis one na for dose of us wey grow up wit pidgin, we love pidgin well-well and we go love to dey follow wetin dey happen for news using pidgin. We dey here for una.