Skip to content

Former Education Minister Kenneth Gbagi Don Die At 62 Years

Kenneth Gbagi

Kenneth Gbagi, wey bin be former minister of state for education, don die. Di former minister die on Saturday and im dey 62 years old.

For statement wey dem post for Facebook, Emuoboh, wey be Gbagi pikin, announce di death of im papa on behalf of di family.

“Na wit deep sadness but tanks to God, we dey announce say our beloved papa, grandfather, husband, and broda don pass on,” na wetin di statement tok.

“Olorogun (Barr.) Kenneth Omemavwa Gbagi, FNIM, OON; former minister of education, comot dis life on di 4th of May 2024 wen im dey 62 years old.”

“We dey take comfort for di fond memories of im life, im achievements, and di impact wey im make for di lives of plenty pipo and communities.”

“We dey kindly ask for una thoughts and prayers for our family during dis challenging time of loss.”

Gbagi bin serve as di minister of state for education under di goment of former President Goodluck Jonathan.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Pidgin Editorial Team

Pidgin Editorial Team

Di Pidgin Editorial team na one group of journalists and writers wey get passion to dey make news available to people for Pidgin English. Dis one na for dose of us wey grow up wit pidgin, we love pidgin well-well and we go love to dey follow wetin dey happen for news using pidgin. We dey here for una.