Skip to content

Isa Dogonyaro, House of Reps Member, Don Die

Isa Dogonyaro

Isa Dogonyaro wey be member of di House of Representatives don die.

Dogonyaro wey bin dey represent Babura/Garki federal constituency for Jigawa State pass away on Friday for Abuja afta e sick small. E be 46 years old.

Na Akin Rotimi, wey be di tok-tok pesin for di House of Representatives, na im break di tori of Dogonyaro death inside statement.

“Hon. Isa Dogonyaro na pesin wey dedicate imsef and get passion as lawmaker wey serve im pipo and di kontri with all im mind,” di statement tok.

“E be ogbonge pesin for di House, as e contribute well-well to how dem take develop laws, especially for di area of HIV/AIDS, Tuberculosis, and Malaria Control, wia e be di Deputy Chairman of di House Committee.”

Rotimi tok say pipo sabi Dogonyaro as “pesin wey get integrity, dey work hard, and no dey shake to fight for di beta of Naija pipo”.

“Im presence go dey missed well-well for di ogbonge chambers of di House of Representatives.

“Hon. Isa Dogonyaro no dey look tribe wen e dey do im work and e dey always jolly as e dey intelligent.

“E build beta friendship with oda Honourable Members from different parts of di kontri.

“E leave im wives and children behind.”

Di tok-tok pesin for di House say dem go do prayers for di pesin wey don die today (Friday) for di National Mosque, Abuja, afta Jumaat prayers, and dem go bury am for Gudu Muslim cemetery, as e follow wetin Islam tok.

For statement to mourn Dogonyaro, Tajudeen Abass, wey be di Speaker of di House, tok say di lawmaker na “broda, friend and Naija pesin wey get mind for di kontri,” come add say im death “pain am well-well”.

Abass say di pesin wey don die “show as e dey determined and dedicated to how e go take build di nation”.

“E be beta pesin and ogbonge lawmaker. As e don go, e go leave big space for di House. We go miss am die,” na wetin di speaker tok inside statement wey Musa Krishi, im special adviser on top media matter, release.

Dogonyaro na member of di All Progressives Congress (APC).

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Pidgin Editorial Team

Pidgin Editorial Team

Di Pidgin Editorial team na one group of journalists and writers wey get passion to dey make news available to people for Pidgin English. Dis one na for dose of us wey grow up wit pidgin, we love pidgin well-well and we go love to dey follow wetin dey happen for news using pidgin. We dey here for una.