Skip to content

NNPC And Fuel Marketers Dey Drag Mouth Ontop Fuel Scarcity Mata

fuel scarcity Nigeria

Di Nigeria National Petroleum Corporation (NNPC) don blame di fuel scarcity wey no gree end for di kontri on top say pipo dey panic dey buy fuel anyhow and some fuel marketers dey play sharp sharp to make more money from di situation.

Di company still tok say di long queues for fuel stations go end by next week, as dem get enough fuel to stop di scarcity.

But di fuel marketers no gree wit wetin NNPC tok, dem say na because say fuel no dey enough na im make di scarcity never end.

Remember say on Tuesday, NNPC tok-tok pesin, Femi Soneye, bin promise say di wahala wey dey ground now for fuel supply and di long queues go end by May 1.

Soneye say NNPC get pass 1.5 billion litres of fuel, wey fit reach pipo use for at least 30 days. E still yan say some pipo fit dey use dis opportunity take make more gain.

Di Major Energies Marketers Association of Nigeria bin release statement say dia members for Apapa and oda places for Lagos don collect 300 million litres of fuel from eight ship dis week.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Pidgin Editorial Team

Pidgin Editorial Team

Di Pidgin Editorial team na one group of journalists and writers wey get passion to dey make news available to people for Pidgin English. Dis one na for dose of us wey grow up wit pidgin, we love pidgin well-well and we go love to dey follow wetin dey happen for news using pidgin. We dey here for una.