Skip to content

President Tinubu go soon carry 2024 Supplementary Budget go National Assembly

Tinubu budget

“I don submit di last budget give una,” na wetin di President yarn wen e dey address joint sitting of di National Assembly on Wednesday.

“Una quick-quick pass am. We dey do wetin we talk. I go soon bring di Year 2024 (Supplementary) Appropriation Bill. Na just to give una info,” na so di President tok for di joint sitting to mark di Silver Jubilee of Naija 4th Republic.

For im response, Senate President Godswill Akpabio say, “Thank you, Oga President, we go dey expect di Supplementary Appropriation Bill of 2024 sharp-sharp.”

Also, for di joint sitting wey happen for di same day wey Tinubu goment clock one year, di President confam say ‘Nigeria, we hail thee’ na di “latest national anthem”.

Tinubu say, “Una sing di latest national anthem, ‘Nigeria, we hail thee’. Dis one show our diversity, wey dey represent all our characters and how we dey blend to be brothers and sisters.”

Di President beg both di Senate and House of Representatives make dem continue to dey work together wit di goment to build di kontri for path of beta progress and development.

“We no get any oda choice; na our nation be dis. No oda institution or pesin go fit help us if we no do am by ourselves. No amount of help from oda kontris or any oda nation (go fix us), dem dey take care of demsef first. Make we work togeda as we dey do now to build our nation, no be only for us but for di generations wey neva born.

Tinubu bin don sign di N28.7 trillion 2024 Appropriation Bill wey Senate pass on January 1, 2024.

Di 2024 budget pass di one wey President bin first propose to joint NASS session on November 29, 2023 by N1.2 trillion.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Pidgin Editorial Team

Pidgin Editorial Team

Di Pidgin Editorial team na one group of journalists and writers wey get passion to dey make news available to people for Pidgin English. Dis one na for dose of us wey grow up wit pidgin, we love pidgin well-well and we go love to dey follow wetin dey happen for news using pidgin. We dey here for una.