Skip to content

Wahala As Ova 100 Hoodlums Attack Police Station For Lagos

Hoodlums attack police station Lagos

Yawa gas for one side of Lagos State on Monday wen ova 100 hoodlums enta Ipaja Police Station like say na dem get am.

Tori be say as di kasala burst, gun begin dey sound upandan between di thugs and police officers. E come be like say plenti of di hoodlums wey carry di attack go join dia ancestors.

Di tin cause katakata for di area and fear come catch everybody as gun dey fire anyhow.

Police don send dia pipo go di area to helep calm di mata.

Wen dem call Oga Benjamin Hundeyin wey be di tok-tok pesin for Lagos police, e confam say true-true di tin happun.

Hundeyin say dem don cool di matter but dem neva arrest anybody.

“We don hold di situation but we neva catch anybody,” na wetin e tok.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Pidgin Editorial Team

Pidgin Editorial Team

Di Pidgin Editorial team na one group of journalists and writers wey get passion to dey make news available to people for Pidgin English. Dis one na for dose of us wey grow up wit pidgin, we love pidgin well-well and we go love to dey follow wetin dey happen for news using pidgin. We dey here for una.