Skip to content

Atiku Talk Say Tinubu dey build Lagos-Calabar Coastal Highway for im own gain

Atiku Abubakar

Atiku Abubakar, di PDP presidential candidate for 2023, don yarn on Sunday say di Nigerian Government dey only dey quick-quick work on di Lagos-Calabar Coastal Highway because of di business wey dey between President Bola Tinubu and Gilbert Chagoury, di oga of Hitech.

Na Chagoury dey handle di highway project.

Atiku talk say dem give di Lagos-Calabar Coastal Highway contract without following di right way dem dey take give contract.

For inside statement wey im Media Aide, Paul Ibe, sign, Atiku talk say di way Tinubu son and im people dey inside di board of companies wey belong to Chagoury na clear conflict of interest.

Atiku still talk say Tinubu son, Seyi, na director for CDK Integrated Industries board.

Di former Vice President say instead of to dey make am easy to do business, e be like say Tinubu government don show di world say na im business and im family own go always dey important pass di kontri own.

Atiku talk say dem dey do di project with more than $13 billion and dem no even do competitive bidding.

Atiku still yarn say dem go give di “so-called” Badagry-Sokoto highway contract di same way with plenty money wey go comot from taxpayers pocket just because Tinubu don put im own interest before Nigerian people own.

Atiku say di way dem take scatter tourist and fun places and oda properties for inside Oniru area, including some parts of Landmark, without enough notice, na one of di reasons why foreign investors no wan put dia money for di kontri.

E add join say for oda better places, dem for don give places like Landmark at least two years notice so dat dem go fit plan well.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Pidgin Editorial Team

Pidgin Editorial Team

Di Pidgin Editorial team na one group of journalists and writers wey get passion to dey make news available to people for Pidgin English. Dis one na for dose of us wey grow up wit pidgin, we love pidgin well-well and we go love to dey follow wetin dey happen for news using pidgin. We dey here for una.