Skip to content

Atiku Yab FG Plan To Borrow N20trn Pension Money Take Do Infrastructure Projects

Atiku Abubakar

Atiku Abubakar, wey bin be vice-president before, don yab di federal goment plan to borrow Nigeria pension money take do infrastructure projects.

For one post wey e put for X on Wednesday, Abubakar talk say na yeye plan and dem must stop am sharp sharp.

On May 14, Wale Edun, wey be di finance minister and coordinating minister of di economy, bin talk say goment don show plan to use di N20 trillion pension money and oda money wey dey inside Naija take develop infrastructure for Nigeria.

Edun say na big step to make Naija economy move forward and to solve di koko infrastructure problems.

But Abubakar don warn say di decision fit spoil tins for Nigerians wey don work hard, save money, and now dey live on dia pension afta dem don retire from work.

“My attention dey on one tin wey di finance minister and coordinating minister of di economy, Wale Edun, talk as e dey yarn with tori people afta di federal executive council (FEC) meeting for presidential villa on Tuesday, 14 May,” na wetin Abubakar talk.

“According to wetin di minister talk, federal goment wan make economy grow by using N20 trillion from pension money and oda money wey dey to take do important infrastructure projects for di kontri.

“Di minister don talk say even though dem dey expect say di plan go bring foreign investment ova time, na domestic savings im wan focus on now now.

“E no give beta details, like how much percentage of di money dem wan comot from pension funds, for example.

“Even sef, dem must stop dis move now now! Na yeye plan wey fit cause wahala for di life of hardworking men and women for Nigeria wey don work and save and now dey live on dia pension afta dem don retire from work.

“Na anoda attempt by federal goment to do wetin no follow law.”

Abubakar talk say make dem warn goment make e follow wetin dey for di Pension Reform Act of 2014 (PRA 2014), togeda with di new Regulation on Investment of Pension Funds Assets wey National Pension Commission (PenCom) give.

“Especially, federal goment no must do wetin no follow di rules wey dey for di Regulation on investment limits wey talk say Pension Funds no fit invest pass 5% of all di pension funds money inside infrastructure investments,” na wetin Abubakar talk.

“I see say as e be for December 2023, total pension funds money na about N18 trillion, and 75% of dis money na investment inside FGN Securities.

“No free Pension Funds wey pass 5% of di total value of pension money for di kontri dey for Oga Edun to dey play with.”

E say no easy way dey to solve di wahala of how to get money for infrastructure development for Nigeria.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Pidgin Editorial Team

Pidgin Editorial Team

Di Pidgin Editorial team na one group of journalists and writers wey get passion to dey make news available to people for Pidgin English. Dis one na for dose of us wey grow up wit pidgin, we love pidgin well-well and we go love to dey follow wetin dey happen for news using pidgin. We dey here for una.