Site icon PidginNews

Govnor Fubara tell Rivers Assembly members say dem no dey exist unless e recognize dem

Siminialayi Fubara

Govnor Siminialayi Fubara of Rivers state don tell di members of di state house of assembly say dia existence dey based on if e recognize dem or not.

Wen some political and traditional leaders from Bayelsa state visit am for Port Harcourt wey be di capital of Rivers state, na im e tok dis one.

Di govnor say di state assembly members no dey “exist” at all, and na only because e decide to “give dem floating” through one peace deal wey President Bola Tinubu arrange na im make dem still dey around.

Govnor Fubara say e gree for di peace accord because e believe say dem get relationship between am and di state house of assembly members.

E still yan say despite all di power wey e get, e don show as e dey calm for di political wahala wey dey rock di state, but di oda party no show dat kain calmness at all.

E still complain say everyday, im supporters dey suffer intimidation and attack for di state.

“Dose group of men wey claim say dem be our assembly members no be assembly members at all – dem no dey exist,” na so Govnor Fubara tok.

“I want make e dey on record. I accept dat peace accord just to give dem small chance. Dat na di truth.

“Notin dey inside dat peace accord wey be constitutional issue. Na political solution to kasala na im e be.

“E don reach time wey I gats make statement say dem no dey exist at all.

“Na me wey allow dem to dey exist. If I remove my recognition from dem, dem no go dey anywhere.”

Tori be say for di past few months, Govnor Fubara and di Rivers state assembly members don dey drag each oda up and down.

For October 2023, di assembly bin wan start impeachment process against di govnor.

But for December 2023, dem come withdraw di impeachment notice.

Plenti times, di assembly don override Govnor Fubara decision not to sign some bills wey dem don pass.

For January, di Rivers assembly override di govnor decision not to gree for four bills wey dem bin pass before.

For March, di assembly do am again for some oda bills.

And for April, dem still do am for di local goment amendment bill.

Just yesterday, di assembly override Govnor Fubara again on top di public procurement amendment bill wey dem pass.

Exit mobile version